Ghana vs South Africa: Bafana Bafana want Fifa to replay World Cup qualifier wit Black Stars

South Africa's football team

Wia dis foto come from, PHILL MAGAKOE

"Robbed" South Africa dey set to tender "formal complain" about "questionable decisions" wey match officials make for Sunday 1-0 defeat by Ghana, says their football association chief.

Bafana Bafana bin need draw to reach di third and final round of African qualifying for di 2022 World Cup, but Ghana win wit controversial penalty.

"Di match officials don decide di game, which no be wetin suppose happun," na so South Africa Football Association (Safa) chief executive Tebogo Mothlante tok.

"We go write to both Caf [di Confederation of African Football] and [world governing body] Fifa - firstly to investigate how dem handle di game was handled and secondly to challenge some of these decisions.

"We don already register wit di match commissioner say we go make formal complaint."

Di Black Stars' narrow win enable dem to reach di African World Cup play-offs, e end South Africa hope as na Ghana top di group on goals scored.

Di referee give Ghana penalty afta Leicester City midfielder Daniel Amartey go down following wetin look like little contact from defender Rushine de Reuck, wey later collect yellow card for di challenge.

Mothlante explain say Safa get concerns over if both di decision and di display of di officiating team from Senegal, wey maguette Ndiaye head bin dey right.

"We dey heartbroken by their actions and we no fit let am destroy di players - when we get di chance to challenge, we go challenge," im add.

"We feel say dem rob us because no be just one single incident of penalty. Many questionable decisions by di match officials bin dey and we go get expert to look into other incidents, so we fit make strong case."

Replay of match don happun before?

South Africa dey well aware say replay of matches fit happun. For 2018, dem bin dey forced by Fifa to replay World Cup qualifier against Senegal afta dem find di referee of di match guilty of match manipulation.

Di South Africans bin don originally beat Senegal 2-1, Fifa later conclude say Ghana referee Joseph Lamptey - 'with di sole purpose to facilitate minimum number of goals to make certain bets successful - clearly take two wrong decisions'.

Dis include award of penalty to Bafana Bafana when referee say Senegal player Kalidou Koulibaly handle di ball, despite replays wey show say di ball hit im knee.

Fifa take unusual step as dem order for replay of di game. South Africa lose 2-0 as Senegal qualify for di World Cup wey Russia host.

"Of course we dey look wetin don happun before whereby Fifa order us to replay Senegal and we tink if justice needs to dey served, make dem take di same decision against dis Ghana game," na so Mothlante add.